To the powers that be
To the powers that be The powers dem get as dem be, The powers that be as dem be He nor easy, see as dem be The powers for land, dem rule big The powers for air, dem rule free The powers for waters, dem swim deep All this powers them, I see As them be As I waka for day, dem nor gree sleep Until their target fall, me But another power get as he be The power that be, him na king Him na king wey big So big, that people shout glory unto thee For everything wey he be So that power na get me, as you see He dey inside me Outside me and he still remain big Oludumare, without thee How I go for feed or sleep How I for even be To those small power who be Who you think say you be,make I see Make way, make my king Show you powers,real Nothing you fit do me Backing dey like this, Do any how to me If I nor go break your wings Bind you for real, like the Conquered things wey you be Omo dada, son of the king ,I be Moving in his wings Like eagles team with ease So you nor dey free Because reignth he over thee Watch out for me I nor small, I be As he don make me king, Crown me priest Over you, wey be as you be
Poetry Books 50% Off
Bestselling collections from top poets
