Survival Mode
Omoh this Life too Tough😔 All the Challenges wey eh just they throw at me too much! 🫣 I no too strong like John Cena💪 upon still, Eh no still consider me Me wey soft like Agege bread😌 Any small stress now I go won bend🥴 Omo e no easy ooh But, upon still man no fit depend on only Agege bread to survive At least, at some point Man gas upgrade to Boku Even that won sef no fit still hold us together Man shall no eat by bread alone If I fit hustle small maybe I fit afford Jollof Rice Abi that won too small? Abeg, I don try na At least I no dey chop only Bread Now, I fit afford Bread and even Jollof Rice At least the little Carbohydrate go make me fat small plus the protein wey don add on top am! Ahn ahnn! I try nah This one don pass butter and bread nah Who knows, If I work a little harder, I Go fit dey able to afford Egusi Soup and Fufu Like this nah, ehn, like this nah, 3 square mean don set🥹 OMG! My Level don upgrade! I know this is what many of us pass through, this is what we are faced with and each time we wished things were different! We wish it wasn't a wooden spoon but a silver spoon or better still a golden one. Even though, Upon still! we go still survive! This one too go pass
Poetry Books 50% Off
Bestselling collections from top poets
